Yoruba Group Rejects US Troops in Nigeria: “We Go Defend Our Land Ourselves” – YOREM Fires Back

By: Abudu Olalekan

E just land like thunder.

Donald Trump open mouth waaa: “If this genocide no stop, we go enter Nigeria guns blazing to protect Christians.” Next thing, him redesignate Nigeria as Country of Particular Concern again. Many people begin clap, especially some church people wey don tire. But one Yoruba group say: Abeg, make una close that chapter sharp-sharp.

Yoruba Revolutionary Movement (YOREM) drop hot statement yesterday. Straight fire. No sugar coating.

Comrade Wale Balogun, their National Coordinator, talk am clear: “We no want American soldier for Yoruba land. Not one. Not even the one wey go dey share chewing gum.”

Him say the killings dey pain everybody, no lie about that. Fulani herdsmen with AK-47, Boko Haram people, all the madness wey dey happen for North and Middle Belt don reach Yoruba doorstep. But solution no be to invite oyinbo wey carry their own agenda come finish wetin remain of our dignity.

“Those people wey dey fuel this crisis with weapons, na the same global powers dey benefit from the chaos,” Balogun hammer. “Today dem go talk say dem wan save Christians, tomorrow dem go begin drill oil or sell more guns. We don see this film before.”

Him remind everybody about Ilorin. How Fulani jihadists take the city plenty years ago, how dem try scatter everywhere until our great-grandfathers stop them for Osogbo 1840. “History dey repeat the beat,” him say. “But this time, we no go wait make dem

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *